One Iranian police officer, Hojjat Vafakardeh, don kpai after gunmen attack am for Saravan city for Iran.
Iran semi-official news agency, Tasnim, report say di officer dey comot from im house when di attackers shoot am.
Di news agency accuse people wey dey work for US and Israel of carrying out di attack.
Tasnim describe di killing as terrorist attack.