OBODO NAIJA

N10 Billion Ebola Fund Na For Different Disease Threats -NCDC

todayNovember 3, 2026 4

Background
share close

Federal Gornment N10 billion emergency fund wey dem approve for June 2026 no be only for Ebola, but to make Nigeria ready to fight different sicknesses.

Dis na according by NCDC, Director-General, Dr Jide Idris, hin tok dis one on Monday while explaining di purpose of di money after Nigeria konfamate first Ebola case.

Hin say dis one pipo dey drag dem for di mow, say dem request di money to improve prevention, early detection and quick response to diseases like Ebola, Lassa fever, cholera, meningitis, diphtheria, measles and monkeypox.

Idris add say Federal Gornment release di money directly to NCDC, not to di Presidential Task Force on Ebola wey Chief of Staff to President, Femi Gbajabiamila, dey head.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds