obodo oyinbo

Eisenkot Say E Go Make Israel And America Relationship Strong

todayNovember 5, 2026 5

Background
share close

Di Israeli opposition leader, Gadi Eisenkot, don promise say if e form di next Gornment, e go repair and make Israel relationship with America strong again. E tok dis one on Wednesday, November 4, 2026, for siddon tok after opposition pipo win di US midterm election.

Eisenkot say di bond between both countries pass ordinary agreement between dia gornment. E say na relationship wey don last for generations, based on democracy and dia shared interest.

Eisenkot say e go work to make both Republican and Democrat pipo for America support Israel again. E also promise to work with America to bring peace, safety and better life for pipo across Middle East. Dis statement come after US Vice Presido, JD Vance, tok on Wednesday say American voters dey demand change for how Washington dey relate with Israel.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds