Naija network providers go scatter dis country, nor be small drama we see untop Channels TV yesterday as presenter Seun Okinbaloye try dial Nigeria national emergency line, 112, live on top TV, nothing come out.
Di tin wey go burst your bololo be say, na after All Progressives Congress chieftain Alwan Hassan dey rake challenge am to test am.
Di APC Presidential Campaign Council, praise di line as big achievement under Presido Bola Tinubu administration for di interview, dem dail number na mpe, nothing come out.