United Nations don bring report card unto di badness wey dey sup for Sudan, say all di pikin wey kpai or sustain wunjur for Sudan war dis year, say wicked bomb bird wey dem call drone strike naim cause am.
Dis na according by UNICEF tok tok pesin, James Elder, wey porporly dis mata Geneva, Seniorman almost burst cry say out of di 410 childrensis wey suffer kpeme between January and September, about 270 of dem na armed drones hit am.
Di UN pikin agency con use di opportunate beg world pipu say make dem some thing fast before di winch bird wey dey call drone go finish all di pikins for Sudan.