Uncategorized

INEC Comot Fake AI From Voters List, Flag Staff For 10 States

todayNovember 11, 2026 4

Background
share close

INEC don comot fake pictures wey AI make from Nigeria voters list and mark some of dia workers for 10 states for punishment.

INEC National Commissioner, Mohammed Kudu Haruna, tok dis one on Wednesday, November 11, 2026, for online meeting wey dem hold about AI and Nigeria 2027 election.

He say some pipo use AI make fake pictures enter voters list, while some others use AI change dia real pictures before dem upload am.

Haruna say e fit hard for INEC to stop ordinary pipo from changing dia pictures, but dem fit deal with dia own workers wey join body do am.

He say dem don get dia names and dem go face punishment.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds