OBODO NAIJA

IGP Tunji Disu Warn Against Fake Election Tori

todayNovember 25, 2026 4

Background
share close

Our pipo get one tok say one rotten tomato fit spoil di whole basket, and na so fake tori fit spoil di general election without one single gunshot.

Di Inspector General of Police, Olatunji Disu, don promise say Nigeria Police go remain professional and neutral towards all political parties ahead of di 2027 general elections.

As e dey tok  for di Media Development Conference for Abuja on Tuesday, November 24, 2026, Disu warn say fake videos, edited audio and organized lies for social media fit attack election without anybody firing gunshot.

E also promise to protect tori pipo and make sure no police officer use im position serve any political party, as di Force dey torchlight physical violence and online misinformation ahead of di polls.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds