Di Independent National Electoral Commission (INEC) don extend deadline for recruitment of election workers (INECPRES) reach December 3, 2026.
For press statement wey Chairman of INEC Information and Voter Education Committee (IVEC), Mohammed Kudu Haruna sign on Thursday, di commission tok say di recruitment exercise wey start on September 18, 2026, suppose end on November 18, but dem don extend am by two weeks after dem review di exercise.
INEC say dem extend di deadline to give more Nigerians wey qualify, chance to apply, and dem urge anybody wey never apply say make dem apply.
Di statement sti tok say, make dem apply through di special portal: pres.inecnigeria.org, before di new deadline.
And anybody wey wan apply suppose remember say na only through di INECPRES portal dem fit register, and dem fit also access am through di commission official website.