by Famosipe Ayomide
Oga dem for three Premier League clubs don dey call make dem force Manchester City owners to sell the club as punishment for breaking financial rules.
According to wetin BBC Sport report on Friday, these rival club officials talk say anything wey no reach to change the club owners no go show how serious City offense be, especially as dem no cooperate with Premier League investigation.
One of the rival oga dem even yarn say any punishment wey no force the current owners comot na pure nonsense.
Dem still add say if nothing serious happen, e go make clubs begin question why dem dey contribute money to fund the independent regulator.