Former Vice President Atiku Abubakar don criticise di Federal Government over di release of abducted schoolgirls for Kebbi State, yan say di girls freedom no suppose be achievement but show how Nigeria security don worsen. Atiku talk say di return of di schoolgirls no be “trophy moment” but na reminder say terrorists dey operate freely, dey negotiate openly, and dey dictate terms while government dey issue press statements to save face. Di statement na response to Presidential Special Adviser on Information, Bayo Onanuga, wey yan how DSS and di military track kidnappers in real time and secure di girls without paying ransom.
Atiku yan say government explanation na attempt to whitewash national wahala and turn incompetence to heroism. He ask why DSS and military no arrest or neutralise di bandits if dem fit track dem and contact dem. He talk say terrorists don become alternative government, dey negotiate, collect ransom, and waka free, while government dey celebrate. Di abduction happen November 17, wey armed men storm Government Girls’ Secondary School, Maga, kill one staff and kidnap 25 students. One girl escape, leaving 24 until dem release Tuesday. President Tinubu welcome di release, commend security agencies, call for more boots on ground, while Kebbi Governor Nasir Idris confirm no ransom pay, and security personnel coordinate di rescue.
National
Abducted Kebbi Schoolgirls Release No Be Victory – Atiku
todayNovember 26, 2025 13

Written by: News Editor 2
Atiku comments Kebbi abduction Kebbi schoolgirls release
Similar posts
National
EFCC Go Pay Whistleblowers Up to 5% for Recovered Loot
todayAugust 26, 2026 9
National
Wike Ban Cars For Abuja Green Areas
todayAugust 19, 2026 15
Konfam Afternoon Lounge
12:00 pm - 4:00 pm
Top popular
1,115 army officers dey sit promotion exam for rivers
Modric, Neymar No Fit Carry Dem Star Power Go Mls
Exam Questions Dey Sell For N3,000 Before Exam
Koval Comot LSU Ova Russian Player
Petrol Cost Nigerians N11.3TN