By: Yusuf Abuh
Adeniyi Adeyemi wey dey claim say na im be Director-General of di Presidential Foreign Investment Promotion Council (PFIPC), don beg wi Presido, Bola Tinubu, say make im set make im set up independent panel to investigate di controversy wey surround di council.
Adeyemi tok dis one for open letter wey e send give di president, saying di panel suppose dey neutral and include different stakeholders.
According to am, civil society groups, independent media, international financial observers and human rights organisations like Amnesty International suppose join di panel.
E still suggest make representatives from di United Nations, United States, United Kingdom, European Union, ECOWAS and African Union, plus ICPC and EFCC as technical partners, take part for di investigation.