Caf Presido, Patrice Motsepe say like dis now Confederation of African Football go follow wetin Court of Arbitration for Sport go decide on di 2025 AFCON wahala.
E yarn dis one for Senegal as dem go collect the trophy from Teranga Lions and give Morocco.
CAF Appeal Committee tok say Morocco na im be di winners with 3-0 even though dem lose 1-0 for pitch, because Senegal players waka comot for match.
Dis decision don cause serious gbege for Senegal, as gornment dey call for investigation over corruption for CAF top people