By: Esther Ayoola
The Akinsanya Olojo family wey dey king Kosoko royal dynasty for Lagos don beg Governor Babajide Sanwo-olu make e approve prince Abiola Olojo-Kosoko as the next oloja of lagos.
Dem talk say prince Abiola don dey oloja-elect since December 12, 2020, but dem never install am even after more than four years.
Dem put the request for one statement wey dem send go the governor and copy other important oga dem like secretary to the state government and Commissioner for local government and chieftaincy affairs.
Prince Theophilus Olojo-Kosoko, wey be general secretary of the Akinsanya Olojo-Kosoko ruling house, confirm the family position again for the statement.