By: Esther Ayoola
Say nor be small badness sup for Badagry, dat De Akran of Badagry Kingdom, Oba De Wheno Menu-Toyi, don die for age 89 afta short sickness on Monday.
Di respected king wey rule Badagry for almost 49 years na strong voice for Lagos State Council of Obas and Chiefs.
Untop yanings with tori pipo, Lagos govo, Babajide Sanwo-Olu, tuk say im death na big loss to Badagry people, Lagos State and Nigeria because of di beta impact wey im make.
Sanwo olu say Di late monarch na ruler wey sabi wisdom, protect culture and push development, as e leave behind legacy of unity and progress.