By: Esther Ayoola
Akwa Ibom State House of Assembly don clear mata, say di social media report wey dey waka up and down, dat dem wan make law wey go jail women wey dey sleep with married men, na fat lie wey dey smell.
Di Assembly tuk tuk put for statement on Monday, say di story wey come from one Facebook post by Obiavel Albert Abigo na fake news.
Dem also clarify say di report wey claim Deputy Governor Senator Akon Eyakenyi ni dey sponsor di bill wey go give women 10-year jail and make men pay 2 million naira fine, nor  be true.
Say make everybody be calming down for Akwa ibom