Trent Alexander-Arnold dey expected to miss up to six weeks with hamstring injury wey e pick during Real Madrid Champions League win over Marseille. Alexander-Arnold, 26, start Tuesday match for Bernabeu but na only five minutes e last as dem comot am sharp-sharp after e injure him left leg. Real Madrid confirm di injury after dem run tests Wednesday morning. Sources dey talk say Trent go dey out for at least one month, and e fit stretch reach six weeks. Alexander-Arnold join Real Madrid on 1st June after Liverpool gree collect fee to release am early from him contract.
Di full-back no even make Thomas Tuchel England squad for this month World Cup qualifiers against Andorra and Serbia, and now e don be major doubt for next month games against Wales and Latvia. E still put am for serious race against time to ready for Real Madrid visit to Liverpool on 4th November, that match suppose be Alexander-Arnold first return to Anfield since e waka commot. Alexander-Arnold don make five appearances for Real during the Club World Cup this summer, drop two assists and don show face five times for all competitions so far for 2025/26 season.