REAL MADRID

16 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

José Mourinho Go Enter Bernabéu As Real Madrid Host Real Sociedad

By: Blessing Aminu José Mourinho go return to Santiago Bernabéu for di first time on Wednesday night as Real Madrid prepare to host Real Sociedad for dia first La Liga home match of di season. Mourinho second spell for Madrid start wit late win against Espanyol, after Carlos Espí score di goal wey give dem victory. Even though Madrid still show some of dia old problems for di match, Mourinho […]

todayAugust 26, 2026 19

Sports

Real Madrid Splash €140m To Sign Yan Diomande

By: Yusuf Abuh Real Madrid don complete di signing of 19-year-old Ivory Coast winger Yan Diomande from RB Leipzig for deal wey fit reach €140 million, and di youngster don sign seven-year contract. Di tin bin dey be like say village pipo dey follow am for back, last last, di transfer, na BBC Sport report on Thursday say Diomande  don become one of di most expensive players wey Real Madrid […]

todayAugust 7, 2026 16

Sports

Arsenal Players Believe Vinicius Jr Transfer Don Near

By: Esther Daniel Reports from Spain claim say Arsenal dressing room don believe Real Madrid star Vinicius Junior fit soon join di Gunners. According to AS, Arsenal players don begin ask questions about di possible transfer after sporting director Andrea Berta reportedly show say di club serious to sign di Brazilian. Manager Mikel Arteta also don reportedly discuss wit Vinicius about d i role wey e go play if e […]

todayAugust 5, 2026 7

Sports

Real Madrid Loan Franco Mastantuono to Fiorentina

By: Esther Daniel Real Madrid on Wednesday agree to send young Argentine midfielder Franco Mastantuono on one-season loan to Fiorentina, as di player go return to Spain by June 2027 to continue im career. Transfer expert Fabrizio Romano confirm di agreement, say both clubs don settle di deal for Wednesday morning. Di loan move make Mastantuono di third Real Madrid player wey don leave di club this week. Earlier, Cesar […]

todayAugust 5, 2026 11

Sports

Cucurella Draw Spain Coachie Face On Top Him Body

Spain defender, Marc Cucurella, don honour World Cup-winning coach, Luis de la Fuente, by drawing di coach tattoo for him body after Spain win di World Cup. Cucurella help Spain beat Argentina 1-0 for di final, as De la Fuente lead di team to another international trophy. Di Real Madrid defender reveal di new tattoo for social media after him £52 million move from Chelsea in June. Di tattoo show […]

todayJuly 29, 2026 13

Sports

Enzo Fernandez Fit Leave Chelsea? former Star Morris Tell Club Make Dem Sell Am

By: Esther Daniel Former Chelsea player, Jody Morris, don advise Chelsea make dem sell midfielder Enzo Fernandez if di player still dey push to leave di club for dis summer transfer window. According to Morris, if Fernandez no get mind to stay for Stamford Bridge, e better make Chelsea cash out now instead of waiting. Di Argentina international wey join Chelsea from Benfica for 2023 don reportedly show interest to […]

todayJuly 27, 2026 12 2

Sports

Atletico Madrid Reject Real Madrid €150m Bid For Julián Álvarez Deal

By: Esther Ayoola Real Madrid don reportedly offer €150 million to sign Argentine striker Julián Álvarez from city rivals Atlético Madrid. Dis na according to statement wey appear for dia website. Di club say di proposal come afta board meeting wey dem hold as dem dey look for top striker to strengthen dia attack. But Atlético Madrid quickly reject di offer, say Álvarez dey very important for dia project and […]

todayJune 10, 2026 12

Sports

Why I Comot Mbappé For Real Betis Game – Álvaro Arbeloa

Real Madrid coachie, Álvaro Arbeloa don explain why e sub striker Kylian Mbappé during dia LaLiga 1-1 draw with Real Betis on Friday. For post-match interview, Arbeloa tuk say say Mbappe feel discomfort during di game against Betis. E sti tuk say dem go see how e go be for coming days. Real Madrid go now face Espanyol for dia next match.

todayApril 25, 2026 20 1

Sports

Bayern Run Comeback Beat Real Madrid 4–3 For Crazy Champions League Night

Say nor be small drama on Wednesday night for Allianz Arena for Germany,  wia Bayern Munich beat Real Madrid 4–3 to qualify 6–4 on aggregate for Champions League semi-final against PSG. Madrid start di match  very fast, as Arda Guler score just under one minute and later add another goal from free-kick, while Kylian Mbappe also score to give them strong fight. Bayern answer back through Harry Kane and other […]

todayApril 16, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds