Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
Manchester United boss Ruben Amorim don para after im players waste plenty chances as dem throway 1-0 lead take draw 1-1 with struggling West Ham for Premier League on Thursday.
Amorim, wey dey fight to drag United comot from 8th position, blame im boys say dem no get killer instinct as dem don repeat di same wahala against Tottenham, Nottingham Forest, and even lose 1-0 to 10-man Everton for Old Trafford.
Di match bin dey under United control after Diogo Dalot score first, but seven minutes to full time, Soungoutou Magassa use corner equalise, leave Amorim dey vex for touchline.
Amorim talk say di team no sabi hold ball at all at all and na so dem lose another two points.
Written by: News Editor 1
MANCHESTER UNITED PREMIER LEAGUE RUBEN AMORIM
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025