PREMIER LEAGUE

19 Results / Page 1 of 3

Background

Sport Yarns

Evra Pick Osimhen As The Dream Striker For Manchester United

By: Esther Ayoola Former Manchester United star Patrice Evra don drop micro soft word, say Naija striker, Victor Osimhen, na di dream player wey United need to buy for next season. Osimhen, wey dey play for Galatasaray right now, once a again don dey get call from Premier League sides. Even though plenty gist don carry am go different English clubs from Merseyside reach West London, no single deal yet. […]

todayMay 26, 2026 10

Sport Yarns

Southampton Collect Ban Say Dem Spy Opponent Training Sessions

By: Esther Ayoola Southampton FC don collect punishment say dem dey spy dia opponent before match. According to independent disciplinary commission, Southampton watch training of Oxford United FC and Ipswich Town FC, and even film Middlesbrough FC before play-off semi-final. So like dis Middlesbrough go take Southampton place for championship playoff final and dem deduct dem 4 point from next season.

todayMay 20, 2026 9

Sport Yarns

Arsenal Finally Break 22-Year Jinx, Carry EPL Title

By: Esther Ayoola Arsenal Football Club don finally win di English Premier League title on Tuesday afta Manchester City draw 1-1 for Vitality Stadium. Dis na di first time for 22 years wey Arsenal go carry di Premier League trophy, afta dem don finish as runners-up for three seasons back-to-back. Manchester City bin need to win to keep di title race alive but dem fall hand beta style. Arsenal go […]

todayMay 20, 2026 9

Sport Yarns

Tottenham Drop Points For Home Draw Against Leeds, Move Closer To Relegation

By: Esther Ayoola Mathys Tel naim be hero and villain, two in one, as Tottenham draw 1-1 with Leeds for dia Monday night Premier League game. E score di first goal for second half to calm fans for Tottenham stadium, but later e cause penalty with one wrong clearance, costing dem di game. Di result mean say, Spurs future for di league dey shaky as dem just dey two points […]

todayMay 12, 2026 9

Sport Yarns

How VAR Hellep Arsenal Escape West Ham Late Equaliser

By: Esther Ayoola Say like dis Arsenal don dey very close to dia first Premier League title in 22 years afta dem beat West Ham 1-0 on Sunday. Leandro Trossard naim score one deflected goal for 83rd minute to settle di tie. Late drama burst when West Ham think say Callum Wilson don equalise afta Raya drop ball for di penalty area. But VAR check show say Pablo foul Raya, […]

todayMay 11, 2026 9

Sports

Fear Grip Arsenal Fans As City Close EPL Title Gap

By: Esther Ayoola Say like dis now, Arsenal fans dey worry as title race don dey tight afta dem lose 2-1 to Bournemouth for Emirates Stadium. Di defeat mean say dia lead don reduce to just six points with Manchester City sti getting one match in hand. City no waste time as dem beat Chelsea 3-0 to show say dem sti dey serious for di race. If City win dia […]

todayApril 13, 2026 12

Sports

Inter Miami Wan Carry Casemeiro

Manchester United Midfielder, Casemiro don get two-year offer to join Inter Miami. According to transfer expert Nicolo Schira, Inter Miami dey talk with di Brazil international for possible move dis summer. Di MLS side wan bring di 34-year-old go United States as free agent from July. Inter Miami don offer Casemiro contract wey go run till December 2028, but e never tuk anything.

todayApril 11, 2026 12

Sports

Bassey Dey Ready For Liverpool Clash

Fulham don get better boost before dia Premier League trip go Liverpool, as dem don confirm say Calvin Bassey don recover and e fit play. Di Nigeria international bin dey doubtful after e comot from Super Eagles squad for March international friendlies because of back problem, wey make am miss matches against Iran and Jordan for Antalya. Im absence bin raise concern whether e go fit play Fulham important match […]

todayApril 11, 2026 11

Sports

Harry Maguire Claim Say Im Na Sti One Of Di World Best Defenders

By: Esther Ayoola Harry Maguire don go drop micro soft words say im sti be one of di best defenders for world football even as age don dey go. Di Manchester United and England national team player yarn dis one for interview with Sport expert, where e confidently rate himself among top defenders. As Fabrizio Romano report for X, Maguire tuk say e sti dey perform well for both defence […]

todayApril 10, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds