MANCHESTER UNITED

23 Results / Page 1 of 3

Background

Sports

Must Read: Di Reason Why Man United Comot For Carabao Cup

First Half As we enter di 10th minutes for Manchester United Carabao Cup match against Brighton, everything dey shine shine for United as Young winger,  Shea Lacey tear net with debut goal. Mason Mount follow am two minutes later with better volley wey bounce for ground before e touch net, and united dey lead 2-0, Old Trafford dey shake, and di night dey look like another step forward for Michael […]

todaySeptember 18, 2026 22

Sports

Carrick Explain Why Rashford Comot for Everton Draw

By: Kofoworola Olayinka Manchester United manager Michael Carrick don explain say Marcus Rashford comot for dia 2-2 draw with Everton after e start dey feel small something for im body. Rashford wey start di match for Hill Dickinson Stadium comot for 70th minute after e give Everton defence plenty palava with im attacking play. Carrick say Rashford don dey sharp since e return to di team, adding say di England […]

todaySeptember 7, 2026 10

Sports

Ander Herrera Go Back To Real Zaragoza

By: Mariam Ajayi Former Manchester United midfielder, Ander Herrera, don return to hin boyhood club, Real Zaragoza, after 15 years away, e say to play for di Spanish side for free na dream come true for am. Di 37-year-old midfielder join on  free transfer from Boca Juniors as e look to help di club rebuild and return to better days. Herrera start hin professional football career with Zaragoza before e […]

todayAugust 27, 2026 13

Sports

Bruno Fernandes Vote Arsenal Player Before E Win PFA Award

By: Kofoworola Olayinka Manchester United captain Bruno Fernandes don reveal say e vote for one Arsenal player to win PFA Player, Player of the Year award before e later win di award himself. Fernandes collect di award for ceremony wey happen for Manchester on Tuesday, after im outstanding 2025/26 season. E reveal dis one for video interview wey PFA post for X on Tuesday night. Na professional footballers vote for […]

todayAugust 26, 2026 14

Sports

Man United Table £60m For Baleba

By: Mariam Ajayi Manchester United don make initial £60 million offer for Brighton midfielder Carlos Baleba as dem continue to strengthen dia midfield ahead of di new season. United bin try sign di Cameroon international last summer but Brighton valuation wey pass £100 million make di deal no happen. But Baleba price don drop significantly and after United fail to sign Matheus Fernandes, dem don return for di midfielder again. […]

todayAugust 19, 2026 21

Sport Yarns

Carrick Back Rashford To Shine For Man United

By: Kofoworola Olayinka Manchester United manager Michael Carrick don back Marcus Rashford to play important role for di club dis season. Carrick talk say Rashford return in good condition and still dey part of im plans for di new Premier League campaign. E make di statement for Thursday after Fabrizio Romano post am for X. Carrick say Rashford na dia player and e dey bring something different to di team.

todayAugust 13, 2026 19

Sports

Heskey Drop Man United Transfer Advice, Enzo Fernandez Fit Be Casemiro’s Successor

By: Esther Daniel Transfer gist dey as former Aston Villa striker Emile Heskey tip Manchester United to go for Chelsea midfielder Enzo Fernandez as di man wey fit replace Casemiro. Heskey yarn say Enzo’s quality and World Cup-winning experience fit give United di strength dem need to battle Arsenal, Liverpool and Manchester City for Premier League title dis season. Casemiro don pack im bag comot Old Trafford for Inter Miami, […]

todayAugust 4, 2026 9

Sports

Manchester United to sign Chelsea Midfielder Andrey Santos 50 million

By Oluwatosin Ibrahim Manchester United and Chelsea don do two aside agree deal for brazil young midfielder Andrey Santos. Say, United go first pay £48 million, while another £2 million go come later if e meet some conditions. Chelsea also go collect 10 percent if Manchester United sell Santos in future. Santos don get permission to do his medical before the transfer complete

todayJuly 9, 2026 20

Sports

Man United Secure Land for New 100,000 Stadium Project

By: Yusuf Abuh Manchester United don announce say dem don secure most of di land wey dem need to build dia new 100,000-capacity stadium. Di club talk say dem buy  25-acre site near dia current Old Trafford home ground. Dis land deal na big step as e go help dem move closer to plan of building one of di biggest stadium for Britain.

todayJune 23, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds