MANCHESTER UNITED

16 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

Manchester United to sign Chelsea Midfielder Andrey Santos 50 million

By Oluwatosin Ibrahim Manchester United and Chelsea don do two aside agree deal for brazil young midfielder Andrey Santos. Say, United go first pay £48 million, while another £2 million go come later if e meet some conditions. Chelsea also go collect 10 percent if Manchester United sell Santos in future. Santos don get permission to do his medical before the transfer complete

todayJuly 9, 2026 13

Sports

Man United Secure Land for New 100,000 Stadium Project

By: Yusuf Abuh Manchester United don announce say dem don secure most of di land wey dem need to build dia new 100,000-capacity stadium. Di club talk say dem buy  25-acre site near dia current Old Trafford home ground. Dis land deal na big step as e go help dem move closer to plan of building one of di biggest stadium for Britain.

todayJune 23, 2026 10

Sport Yarns

Amorim to Pick Up AC Milan Coaching Job

By : Jolayemi Olajide Dem really tuk say, one man food na another man poison, say former man united coachie, Ruben Amorim don dey close to become AC Milan new coach Dis na according to report from Italy,  Milan go  later this week to sign two-year contract. The 41-year-old Portuguese manager go replace Massimiliano Allegri, wey dem sack after poor results  wey make Milan miss Champions League qualification.  

todayJune 15, 2026 11

Sport Yarns

Man United Don Finalize Busy Pre-Season Play With AC Milan For Poland

By : Jolayemi Olajide Manchester United don announce on Tuesday say dem go finish dia tight pre-season preparation against AC Milan for Wroclaw inside Poland. Di big match go hold on August 15 as coach Michael Carrick dey plan to build on top di beta third position wey di club carry last season before di new Premier League start. United go start di matches against Wrexham for Helsinki on July […]

todayJune 9, 2026 12

Sport Yarns

Evra Pick Osimhen As The Dream Striker For Manchester United

By: Esther Ayoola Former Manchester United star Patrice Evra don drop micro soft word, say Naija striker, Victor Osimhen, na di dream player wey United need to buy for next season. Osimhen, wey dey play for Galatasaray right now, once a again don dey get call from Premier League sides. Even though plenty gist don carry am go different English clubs from Merseyside reach West London, no single deal yet. […]

todayMay 26, 2026 12

Sports

Sir Alex Ferguson Land For Hospital Before Man Utd vs Liverpool

Manchester United legend manager, Sir Alex Ferguson, don land hospital after health matter catch am for Old Trafford. Di incident happen just before Sunday Premier League showdown between Red Devils and Liverpool. According to BBC, no be life-and-death emergency, na to play safe dem rush am go hospital. Even with that one, Sir Alex still comot di stadium inside ambulance. People for United camp dey confident say di Ferguson go […]

todayMay 3, 2026 21

Sports

Mainoo Sign New Man United Deal Till 2031

By: Esther Ayoola Kobbie Mainoo don sign new contract with Manchester United wey go keep am for club till 2031. Di 21-year-old midfielder wey join di academy since 2014 don already play 98 matches, even score di winning goal for 2024 FA Cup final and represent England for Euro 2024 final. Mainoo talk say Manchester United na im home and di club mean everything to im and im family. E […]

todayApril 30, 2026 14

Sports

Inter Miami Wan Carry Casemeiro

Manchester United Midfielder, Casemiro don get two-year offer to join Inter Miami. According to transfer expert Nicolo Schira, Inter Miami dey talk with di Brazil international for possible move dis summer. Di MLS side wan bring di 34-year-old go United States as free agent from July. Inter Miami don offer Casemiro contract wey go run till December 2028, but e never tuk anything.

todayApril 11, 2026 15

Sports

Harry Maguire Claim Say Im Na Sti One Of Di World Best Defenders

By: Esther Ayoola Harry Maguire don go drop micro soft words say im sti be one of di best defenders for world football even as age don dey go. Di Manchester United and England national team player yarn dis one for interview with Sport expert, where e confidently rate himself among top defenders. As Fabrizio Romano report for X, Maguire tuk say e sti dey perform well for both defence […]

todayApril 10, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds