By: Rilwan Agbomeji
Amotekun for Ondo State don catch 39 people wey dem say na from Sokoto State, wey dem hide for forest afta US-backed military strike against ISIS for North.
According to report, say dem catch dem for Elegbeka area for Ose Local Govment, wey don long dey known as place wey bad people dey.
State Commander, Adetunji Adeleye, talk say dem dey hide for forest, and dia cars dey park far from where dem dey hide.
Amotekun yarn say anybody wey wan dey for forest must get government permit, because any kpakam like dem go enter bush arrest anybody wey dem see for security purpose.