Amotekun senior men officers inside Ondo State don do james bond rescue one person wey kidnappers carry and dem arrest one papa join his three sons for Oba Akoko area.
Di Amotekun Commander, Adetunji Adeleye, say dem catch di papa, Iliasu, and im pikins dem, say dem turn kidnapping to family business.
Dis na after di victim papa report to dem.
Dem catch di suspects with different things like drugs, drinks, and camouflage load wey dem dey use cover the eye of person wey dem kidnap.