Lagos

APC Govos Gather For Lagos To Plan Next Convention

todayMarch 24, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Say nor be small tin, dat Govos wey dey under All Progressives Congress gather demselves for Lagos on Monday oh, to strengthen unity and plan ahead for coming political activities.

Di meeting wey happen for Victoria Island, say na part of effort to align leadership and prepare di party wella for future elections.

Untop yarnings with tori pipo afta di meeting, Chairmo of APC Govos family meeting, Hope Uzodimma, explain every wey sup for di meeting, say na to review dia successful congresses, discuss plan for next convention.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app