Lagos

APM Governorship Candidate Laja Adeoye Promise 4th Mainland Bridge

todayMay 18, 2026 5

Background
share close

By: Esther Ayoola

One Lagos governorship candidate, under di canopy of Allied Pipos Movement, Prince Laja Adeoye,  don promise say im go build 4th Mainland Bridge and create Amotekun Corps if im win 2027 election.

Adeoye yarn dis on Sunday as im bin dey tell im pipo about im “RESET LAGOS Agenda 2027” wey dem tag “Àtunto Èkó 1.0, Re-Engineering Lagos for Inclusive Prosperity.”

According to am, di plan, na to hellep fight insecurity, unemployment, bad roads and social exclusion for Lagos State.

Adeoye sti press tuk dat, Lagos pipo deserve beta leadership wey go bring transparency, accountability and development reach every part of di state.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds