By: Esther Ayoola
Nigerian Army don start investigation into death of one 13-year-old boy wey dem allege say soldier shoot for Ikot Abasi Local Government Area of Akwa Ibom State.
Di incident happen early momo of January 1, 2026, for Akongntekong Road, Ete, and e cause serious anger and tension for di community.
Army Public Relations Officer for 2 Brigade, Mbiokporo, Captain Lawal Mohamed, tuk say Military Police don take over di matter and due process go follow.
Witnesses tuk say di boy, Timothy Daniel, dey return from crossover service for Mount Zion Full Gospel Church with him 15-year-old sister when di incident happen around 12:05 a.m.