Lagos

Aspirants Accuse Speaker Obasa Of Cornering Election Results For Agege

todayMay 22, 2026 3

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Fresh wahala don burst inside Lagos APC as one House of Assembly aspirant for Agege Constituency II, Mutiu Oladebo, wey many people know as Okadigbo, dey accuse di Speaker, Mudashiru Obasa, say im corner di primary election results.

Okadigbo claim say na im clear di direct primary election, but di Speaker use power from above change di game to give di ticket to another aspirant wey dem dey call Azeez Ninalowo.

As if dat one no do, supporters of Gbenga Abiola (wey dem dey call Agbelebu) don also reject di primary election result for Agege Constituency I, as dem dey shout say no genuine voting hapun for di area.

But Speaker Obasa don wave all di allegations comot, im tuk say di election pure and dem follow all party rules, and dat any person wey nor like am, make dem go court.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds