Sports

Aston Villa Lash Freiburg 3–0 To Lift Di European Cup

todayMay 21, 2026 7

Background
share close

Aston Villa do correct work on Wednesday night as dem lash SC Freiburg 3–0 for di Europa League final to lift di European cup wey dem don long for.

As just blow start whistle, Unai Emery boys nor give Freiburg space to breath, as dem use heavy pressing and fast-fast passes pin dem for back.

Di first goal come for middle of di first half after Villa use eye follow Freiburg defenders wey dey look Uche, before dem sharp-sharp score di opening goal.

Freiburg try all dem fit try, but things nor just balance for dem, as Villa arrange dia midfield gidigba to cut every move wey di German side wan make.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds