Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Opposition political leaders don gather for Ibadan, Oyo State, for national summit wey aim to strengthen unity and coordination among parties for Banquet Hall, Oyo State Government House.
For statement wey dem drop for PDP official X page, organisers talk say di meeting na strategic move to tackle di challenges wey dey face di country.
Oda politicians like Former Vice Presido, Atiku Abubakar and Former Kano Govo, Rabiu Kwankwaso also post for dia X page say dem arrive for di summit for Oyo State.
Reports on Saturday show leaders from PDP, ADC, NNPP and other parties dey di Pacesetter State.
Dem also confirm Former Presido Olusegun Obasanjo as chair of di meeting, while Oyo State Govo, Seyi Makinde na host.
Written by: Rilwan Agbomeji
ELECTIONS opposition meeting summit Oyo State Seyi Makinde
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026