By: Kofoworola Olayinka
ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don talk say e go restore petrol subsidy if e win di 2027 election because Nigerians never see how gornment use di money wey dem save.
Atiku talk dis for BBC Hausa interview on Friday while explaining how e wan tackle di hardship wey Nigerians dey face.
E say e no oppose di removal of petrol subsidy, but e dey question where di money wey gornment save from am don go.
Atiku say di money wey government save from subsidy removal suppose dey used to reduce poverty, unemployment and insecurity.
E question di whereabouts of di reported ₦30 trillion, saying Nigerians suppose benefit from di money.