News-auth

322 Results / Page 29 of 36

Background

Niger Delta

FG Revive 450mw Geregu Plant

By: Alice Iduh Wi Federal Government don cure di crase wey dey worry di 450 megawatts enter national grid  after one heavy four-week maintenance for Geregu NIPP plant for Kogi State. Dem talk say dis work boost di plant reliability, make am run sharp-sharp, and even extend deir operating hours so di station fit deliver better light for Nigerians. Head of Corporate Communications, Emmanuel Ojor, yarn dis one on Monday […]

todayDecember 9, 2025 9

National

India Deport 32 Naija Suspects Say Dem Go Sell Weed For Obodo Oyinbo

By: Esther Ayoola Kwake yoyoo, awhoo, say Indian authorities don bundle 32 Nigerians comot for their country says dem join body for  one deadly transnational drug cartel. According to Reports, investigators trace di whole operation reach one Naija kingpin wey dem dey call “Nick,” wey don waka disappear and dey wanted for plenty drug cases. Elite Anti-Narcotics Group officers still  join bodi tuk their own that,  all di Nigerians wey […]

todayDecember 9, 2025 5

Niger Delta

Police Hunt Gunmen Say Dem Attack Imo Community

By: Alice Iduh Nor be small gbege for imo state , say  gunmen  go burst Amala Community, Ngor Okpala, Imo State, open fire for one Toyota Highlander and kpai di driver on di spot. Dem later drag di passenger from  one Lexus commot, and up till now the poice never sti fit confirm how many pipo dem carry. Police PRO, Henry Okoye, yarn say di wounded driver wey dem rush  […]

todayDecember 9, 2025 7

Lagos

Accident Scatter Lagos Ogun Road

By: Esther Ayoola Better  two days never pass wey  two people kpie for Ososa, Ogun State, another badness don sup again for  early  mor mor on Monday, say  one truck driver and him passenger kpai instantly after their truck jam trailer from back. Lagos State Traffic Management Authority (LASMA) spokesperson Adebayo Taofiq confirm say di crash happen for midnight when di truck run enter di trailer wey dey front. Same […]

todayDecember 9, 2025 6

Lagos

Sanwo-Olu Clear Area For Investors Say Make Dem Con Invest

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu don  turn loyal governor, dey hail both local and foreign investors say,  make dem con invest for lagos. Di governor yarn dis one on Tuesday when him commission one Ogbege logistic company for Alaro City inside Lekki Free Zone, a mega warehouse and trading hub. Sanwo-Olu talk say di new project na big boost to Nigeria logistics and supply chain system and […]

todayDecember 9, 2025 4

south east

AAC Ginger Anambra Gorment Over Badness Of Jaguda

By: Alice Iduh Di African Action Congress don tear shirt condemn di December 7 gunmen attacks wey shake Nawfia for Njikoka LGA and one church for Lilu, Ihiala, saying di kain wahala no fit continue again. Party  tuk tuk persin, Anyanwu Chinedu,  ni dey clear newsmen  how im pipo dey in pain and clear  di Anambra State government sharpaly  do security reforms. Chinedu shout say make authorities take sharp-sharp action […]

todayDecember 9, 2025 6

National

Govo Bago Express Hapiness As Im Receive The 100 Papiri School Pikins

By: Alice Iduh Nor be  small happiness one finish   niger state govo, Umaru Bago for face, as  im ma  receive di 100 pikins wey jaguda boyz bin kpake   from st. Mary’s catholic school for papiri afta federal gornment secure dem. Di matter be say, how security take rescue di childrensis, nor  sti dey clear oh, whether, na  mind rob oh with the jaguda boys, abi na force, or whether dem […]

todayDecember 9, 2025 3

National

Vice Presido Shettima Enter Abijan Dey Preach Peace

By: Alice Iduh For swear wi oga Vice Presido Kashim Shettima go swear,  e don turn preacher, dey preach peace say, Nigeria tanda gidigba for any peace matter  for the  West Africa. Wetin Shettima talk, follow  aproko pipo mouth, when e represent President Bola Tinubu for the inauguration of President Alassane Ouattara for Abidjan, praise Ouattara leadership and talk say e get confidence for im new term. E still carry […]

todayDecember 9, 2025 2

Lagos

Lagos Traffic Arrest Ambulance Driver Say Im Wunjor Dispatch Rider

By: Esther Ayoola Nor be small gbege oh, between Lagos State Traffic Management Authority and  one ambulance driver,  say im go,  wunjor one delivery rider for leg for Odo Iya-Alaro bridge wey dey go Maryland along Ikorodu road. The two  both of dem drag demsleves for  traffic wella wella, nor be small. Lagos state traffic management agency tuk tuk person, Adebayo Taofiq, confirm the matter for statement on monday. Wey […]

todayDecember 9, 2025 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app