News-auth

1164 Results / Page 29 of 130

Background

National

Oga Presido Tinubu Send Letter Of $6B Foreign Loan To Senate

Wi oga Presido Bola Tinubu, don enter senate again dey ask dem to approve $6 billion loan from outside to help run gornment. Na for two separate letters request  him send to Senate President Godswill Akpabio and naim im put dis one and dem read during Tuesday’s plenary. For one letter, e dey seek $5 billion from Abu Dhabi Bank to hellep finance budget. For another letter, e ask for […]

todayMarch 31, 2026 12

National

New Ogun Cp Ojajuni Officially Report For Duty Post

Ogun State new Police Commissioner, Bode Ojajuni, don resume work yesterday for Ogun State say im go ensure law and order Di CP say im go make sure say im officers respect pipo rights and follow law and rules. Ojajuni con sti beg bed di public make dem dey respect police and join hand with dem to fight crime

todayMarch 31, 2026 17

National

President Tinubu Tell Security Make Dem Hunt Killers Weh Attack Plateau, Kaduna

Wi oga Presido, Bola Tinubu don tell security mehn make dem hunt down di jaguda boys wey dey behind di killings for Plateau State and Kaduna State. Nor be amebo say Gunmen kpai about 28 pipo for Angwan Rukuba, Jos, and some others attack Kahir village for Kaduna, kill plenty pipo. Tinubu say di kpaing and wedding abduction na shame for Naija and make security agencies dey pursue di criminals […]

todayMarch 31, 2026 13

National

Former Deputy Kano State Govo Gawuna Catapult From APC

Former Kano State deputy governor, Nasiru Gawuna, don resign from All Progressives Congress. Im write letter go di APC chairmo for Gawuna Ward, Nassarawa Local Government Area,  say na im own personal decision, and e effective March 29, 2026. Gawuna thank di party for di opportunity wey e get as member. Him resignation follow im 2023 governorship ambition for APC wey nor work and aside dat one, im nor give […]

todayMarch 31, 2026 14

National

FG Get Approval From UK, US, France, Others To Send Ambassadors

Federal Gornment don konfam say some countries don approve Naija ambassador nominees, including United Kingdom, France and United States, as dem dey try fill empty diplomatic positions. Foreign Affairs Ministry tuk, tuk, Kimiebi Ebienfa, tuk dis one for statement wey dem release on Monday, say about ten countries don give approval so far. Dem call dis approval “agrément”, wey mean say di kontry don accept di ambassador, so di person […]

todayMarch 31, 2026 12

Sports

Kenya Drop $30m, Secure 2027 AFCON Hosting Slot

Kenya don pay $30 million give Confederation of African Football to secure dia place as one of di countries wey go host 2027 AFCON. Minister for Sports, Salim Mvurya, naim share dis update to tori pipo, say dis payment show say Kenya readiness. E sti mention say gornment don set up new Multi-Agency Local Organizing Committee to plan everything.

todayMarch 31, 2026 12

Sports

Ghana Football Association Sack Otto Addo Afta Germany Friendly Loss

Ghana Football Association don sack coach Otto Addo on Tuesday, few hours afta dem lose friendly match 2-1 to Germany for Stuttgart. Na late goal from Deniz Undav make Germany win di match, as e be say Ghana don lose four matches back-to-back, including 5-1 beating from Austria last week. GFA thank Addo for im work but say dem go soon announce new coach as Black Stars dey prepare for […]

todayMarch 31, 2026 21

Sports

Newcastle Stand Fit With Coach Eddie Howe

Newcastle United don clear matas say dem nor dey change dia coachie, Eddie Howe, go remain head coach till end. Rumour bin dey fly say based on Newcastle poor form, say di board wan drive di Howe However, club Chief Executive, David Hopkinson, don clear di mata on Tuesday say, dem nor get any plan to change coach. Hopkinson press tuk say di club dey prepare for summer transfer window, […]

todayMarch 31, 2026 19

Sports

Senegal To Show AFCON Trophy For Home Fans, Snub CAF Decision

Senegal Football Federation tuk say dem go parade dia AFCON 2025 trophy on Tuesday for Abdoulaye Wade Stadium during friendly match against Gambia, as part of pre-match ceremony. Dem yarn dis one for official programme wey dem post, say gate go open 2pm, show start 4pm, and trophy presentation go happen by 5:45pm before kick-off 7pm. According to dem, di move na to celebrate with home fans and show say […]

todayMarch 31, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds