News-auth

697 Results / Page 58 of 78

Background

National

Governor Otti Clear Matas Dat Im Support Obi Move To ADC

By: Esther Ayoola Abia State Governor, Alex Otti, don clear say e no get plan to waka comot from Labour Party like Peter Obi wey be 2023 presidential candidate. Otti tuk dis one on Tuesday during him monthly media briefing wey hold for Umuahia, Abia State capital. Governor yarn say Peter Obi don personally tell am say e wan leave Labour Party. Otti add say e dey fully support Obi […]

todayDecember 31, 2025 12

National

PDP Explain Why Governors Dey Defect To Di APC

By: Esther Ayoola Di Pipos Democratic Parti don put accusation for wi Federal Government head, say, dem dey marginalise governors, ni make everi bodi dey run enter all progressives congress. PDP tuk, tuk, Ini Ememobong, clear dis one for TV sitdon tuk, say many governors wey don leave PDP dey do am to “connect to centre make dem fit carry benefits go back dia states.” E add say, di Tinubu […]

todayDecember 31, 2025 5

obodo oyinbo

Operation Hadin Kai Troops Catch Suicide Bomber

By: Esther Ayoola Troops of Operation Hadin Kai don record big win for Borno State as dem arrest one suspected suicide bomber. The man, Abubakar Mustapha, say bindey Banki town for Bama LGA wia security agents catch am with materials wey fit make Improvised Explosive Devices (IEDs). Lt. Col. Sani Uba talk say preliminary investigation show say Mustapha dey plan attack and dem dey interrogate am to find him sponsors […]

todayDecember 31, 2025 8

National

Why Peter Obi Choose Enugu Take Join ADC

By: Esther Ayoola Leader of Obidient Movement, Dr. Yunusa Tanko, address matas why  labour party 2023 president candidate,  Peter Obi pick Enugu State take join ADC, say na  to pass strong political message ahead of 2027 elections. Speaking with tori pipo, Tanko say Obidient leaders and supporters wey back Obi for 2023 don already dey Enugu for di defection event. Tanko say Obi choose Enugu instead of Awka because Enugu […]

todayDecember 31, 2025 3

Sports

FRSC Investigate Joshua Road Crash

By: Esther Ayoola Untop di updates of di accident wey involve Nigerian boxing star Anthony Joshua, say di federal road safety don dey touchlight di mata unto wetin really cause di accident Di Federal Road Safety Corps (FRSC) yarn on Tuesday say dem dey wait full technical report to know di exact reason for di crash. Untop yanings for TV sitdon tuk, FRSC spokesperson Olusegun Ogungbemide tuk say preliminary assessment […]

todayDecember 30, 2025 19

Sports

British Deputy Head Visit Anthony Joshua For Lagos Hospital

By: Esther Ayoola Di Deputy Head of Mission for British High Commission, Simon Field, don visit world heavyweight boxing champion Anthony Joshua for hospital after di deadly road accident for Lagos–Ibadan Expressway. According to statement from Special Adviser on Information and Strategy to Ogun State Governor, Kayode Akinmade, dis one hapun on tuesday. Say, Field also meet Ogun State Governor Dapo Abiodun and Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu to discuss […]

todayDecember 30, 2025 18

National

Kebbi Police Take Over Bagudo Hospital Afta Explosion For Bagudo

By: Esther Ayoola Di Kebbi State Police Command don assure residents say security don return to normal afta one loud explosion happen for General Hospital, Bagudo, early Tuesday morning. Di assurance come from di Police Public Relations Officer, SP Bashir Usman. Police tuk say joint security team wey include Nigeria Police, military, and local vigilante dem quickly block and secure di area. Dem also send Explosive Ordnance Disposal and CBRN […]

todayDecember 30, 2025 5

obodo oyinbo

Yemen Rights Group Drag UAE For Weapons Wey Dem Send Go Mukalla

By: Esther Ayoola Yemeni Network for Rights and Freedoms don carry hammer knack UAE for head say make dem hear word on Tuesday, say make UAE stop di bad character of sending weapons and heavy military equipment go di port of Mukalla in southern Yemen. According to di Yemeni right pipo, say, di move dey break international law, dey violate UN ban on arms, and dey put civilians life, oil […]

todayDecember 30, 2025 10

National

Malami, Him Son Plead Not Guilty Before Justice Nwite

By: Esther Ayoola Former AGF and Minister of Justice, Abubakar Malami, him son Abubakar Abdulaziz Malami, and one other person, on Tuesday, don plead not guilty to 16-count money laundering charge, EFCC talk. Dem appear before Justice Emeka Nwite for Federal High Court, Abuja, where EFCC say dem conspire to hide, disguise, and keep money wey dem get from illegal activities. EFCC filed di charge, saying dem allegedly buy properties […]

todayDecember 30, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app