By: Esther Ayoola
Untop di updates of di accident wey involve Nigerian boxing star Anthony Joshua, say di federal road safety don dey touchlight di mata unto wetin really cause di accident
Di Federal Road Safety Corps (FRSC) yarn on Tuesday say dem dey wait full technical report to know di exact reason for di crash.
Untop yanings for TV sitdon tuk, FRSC spokesperson Olusegun Ogungbemide tuk say preliminary assessment show say excessive speed fit be main reason, and dis fit explain why two of Joshua’s friends die instantly while Joshua survive with minor injuries.