News-edi 1

1370 Results / Page 101 of 153

Background

National

One Lost, Two Wound As Thieves Raid Osun Varsity Hostels

Two students for Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, chop injury as armed robbers wey carry cutlass and gun invade some off-campus hostels for night attack wey happen around 11pm on Monday. Di robbers break windows, wound students and carry waka with phones, MacBook, money and other belongings. One student wey no gree drop him phone chop cutlass injury. Dem still go attack another hostel, Peace Hostel, collect wetin students get. Students […]

todayOctober 22, 2025 9

National

Kano Court Don Order TikTokers Make Dem Marry Within 60 Days

Magistrate court wey dey for Kano don order two popular TikTokers, Idris Mai Wushirya and Basira Yar Guda, make dem marry within 60 days, based on viral videos wey di Kano State Films and Video Censorship Board tag as “indecent.” Di video clips show di two dey do romantic touching and body movement wey authorities talk say e no follow di moral and religious values wey Kano State dey stand […]

todayOctober 22, 2025 13

Sports

Haaland Don Show Power Again As Man City Run Villarreal Street

Erling Haaland still dey hot as e score again make Manchester City collect easy 2-0 win for Villarreal for Champions League on Tuesday. Pep Guardiola side no lose since dem start league phase as Haaland open scoring before half with help from Rico Lewis, then Bernardo Silva add second goal to kill Villarreal momentum. Haaland don score for each of him last 12 games for club and country, rack up […]

todayOctober 22, 2025 10

Sports

PSG Beat Leverkusen 7-2 For UCL

Ousmane Dembele show im return from injury sharp sharp as PSG run Bayer Leverkusen street 7-2 for Champions League match wey happen for BayArena stadium, Germany. Dembele score PSG sixth goal just three minutes after im enter second half for im first game since im hamstring injury from September. Desire Doue score two goals, while Willian Pacho, Khvicha Kvaratskhelia, Nuno Mendes and Vitinha add dia own goal as PSG show […]

todayOctober 22, 2025 6

Sports

Newcastle Thrash Mourinho Benfica For Champions League

Harvey Barnes score two goals from bench as Newcastle carry 3-0 hammer land Jose Mourinho Benfica for Champions League showdown for St. James’ Park. Anthony Gordon open di scoring for first half, as Benfica still dey waka with zero point for dis Champions League season. Barnes enter after one hour play and scatter di show with two correct right-footed finishes wey help Newcastle dey on track to qualify from di […]

todayOctober 22, 2025 10

Sports

Cristiano Ronaldo Pikin Don Get Him First Call-Up To Play For Portugal U16 Team

Cristiano Ronaldo pikin, Cristiano Ronaldo Jr, don get him first-ever call-up to Portugal U16 team. Di 15-year-old wey dey play for Al Nassr youth team for Saudi Arabia, same club where im papa dey ball, land inside 22-man Portugal squad wey go play for di Federations Cup Tournament for Turkey. Di tournament go run from October 30 to November 4, and Portugal go face Turkey, Wales and England for di […]

todayOctober 22, 2025 10

Sports

LaLiga Don Cancel Barcelona vs Villarreal Match Wey Dem Wan Play For Miami

LaLiga don cancel dia big plan to play Barcelona vs Villarreal match for Miami dis December. Dem announce am on Tuesday say na Relevent, di league’s partner for North America, pull plug because of di wahala and kata kata wey di match don cause for Spain. According to LaLiga, di mata don bring serious gbas gbos and uncertainty for Spain, so dem no fit go ahead again. Dem talk say […]

todayOctober 22, 2025 8

Sports

Lopez, Rashford Dey Hot As Barca Thrash Olympiacos 6-1

Fermin Lopez bag hat-trick and Marcus Rashford score two as Barcelona knack Olympiacos 6-1 for Champions League group stage match on Tuesday. Di Catalan giants bin need dis win after dem lose to PSG last time, and dem no waste time bounce back. Teenage baller Lamine Yamal still chop goal as Hansi Flick men, wey dey short of top players like Lewandowski and Raphinha, run riot for Estadi Olímpic Lluis […]

todayOctober 22, 2025 13

Sports

Arsenal Na Kings of Spain, Gunners Smash Record After Dem Wipe Atletico

Arsenal raise plenty eye for Europe after dem hammer Atletico Madrid 4-0 for Emirates Stadium on Tuesday night. But no be only one-off win for Mikel Arteta side, na historic run dem dey make as dem don win seven straight games against Spanish teams for Champions League, something no other team don ever do before. Dem beat Atletico after dem already knack Athletic Club, Real Madrid (home and away), Girona, […]

todayOctober 22, 2025 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app