News-edi 1

2355 Results / Page 100 of 262

Background

Sports

Nigerian Athletes Scarra US NCAA

Say Nigerian student-athletes don scatter ground for US over di weekend, carry 32 medals for 2026 NCAA indoor conference championships. For SEC side, 19-year-old Samuel Ogazi from Alabama run 44.72s for men 400m, break African and Nigerian record as e carry gold. LSU athlete Ella Onojuvwevwo  shine wetin nor good, win women 400m with personal best 50.96s to become one of di fastest African women ever for indoor race. Kayinsola […]

todayMarch 2, 2026 20

OBODO NAIJA

First Lady Open Church For NASS, Say Make Lawmakers Sef Dey Go Church

Wife of Presido, Oluremi Tinubu, on Sunday for Abuja don do open National Assembly Christian Fellowship Chapel wey go contain, 750 people inside National Assembly complex. For her tuk, tuk, Mama Oluremi package wetin nor good for di chapel, say na sign of accountability, remind lawmakers say every bodi go give account one, day, by one day, particularly those once wey dey bring law wey press pipo neck. She sha […]

todayMarch 2, 2026 15

OBODO NAIJA

Presido Tinubu To Hold Police Council Meeting To Konfam Disu As New IGP

Say wi oga Presido Bola Tinubu don dey press cloth to hold Nigeria Police Council meeting on Monday for Abuja to touch light Olatunji Disu as new Inspector-General of Police. One oga for Presidency yan say, di Police Council Meeting na Monday, while another senior police source confirm am on Saturday, say dem dey plan am around 12:00 or 1:00 pm. Di meeting dey follow Police Act 2020 wey say, […]

todayMarch 2, 2026 15

Obodo Niger

Ogun Chiefs Clear Ilaje Pipo To Stay Away From Eba Island Oil Land

Ogun Waterside traditional chiefs don explain how Eba Island, wey dem wan start commercial oil drilling take be dia own say, Ilaje pipo from Ondo claims of di land na big lie. Dis dey come, after when Ogun State Govo Dapo Abiodun announce on January 22nd say Ogun don officially join oil-producing states, following President Bola Ahmed Tinubu approval. According to report, Govo Abiodun, don receive di Flag Officer Commanding, […]

todayMarch 2, 2026 14

obodo oyinbo

Trump Say Fight With Iran Fit Last Four Weeks

U.S. Presido Donald Trump say di fight with Iran fit last four weeks. E tuk dis one for interview, say di country big, so e go take about four weeks or less. And from report say na three U.S. soldiers don kpai and five get serious wunjury. Trump dey praise im soldiers wey die, call dem “great people and dat, Iran must hear word.

todayMarch 2, 2026 15

obodo oyinbo

Hezbollah Fire Rockets, Drones Enter Israel To Revenge Iran Attack

Hezbollah for Lebanon say dem don fire rocket and send drone to military base for south of Haifa for Israel. Dem say na revenge for Iranian oga Ali Khamenei wey kpai afta U.S. and Israel attack for Tehran. However, Israel tuk say dem don fire back Hezbollah for Lebanon and no go do wahala with dem. Lebanon PM Nawaf Salam say, im ready to protect im pipo to di fullest.

todayMarch 2, 2026 11

obodo oyinbo

Iran Attack Ship For Strait of Hormuz

Global oil price don jump up afta jaguda pipo go attack at least three ship for Strait of Hormuz. UK Maritime Trade Operations Centre (UKMTO) report, na im dey report dis one say, di jaguda boys attack Two ship for Kena. Say dis one sef na based on say Iran dey strike back Middle East aftA  US and Israel bomb Iran. Iran don warn say dem nor go allow any […]

todayMarch 2, 2026 16

Sports

Remo Stars Break Seven-Game Curse, Hammer Katsina United 2-0

Remo Stars don finally break dia seven-game winless run, beating Katsina United 2-0 for Ikenne on Sunday. Haruna Hadi na di main guy, wey score di  two goals afta di first half end 0-0. Coach Usman Abdallah, wey just take over last Thursday, enjoy im first big win with di team. Before now, Remo Stars never win since dem knack Ikorodu City 1-0 for January 14.

todayMarch 2, 2026 11

Sports

Arsenal Beat Chelsea 2-1 For London Derby

Arsenal don extend dia lead for di English premier league table, beating  Chelsea 2-1 for Emirates Stadium. William Saliba score di first goal,  and na im first goal since December 2024 put Arsenal first. Chelsea come equal with Piero Hincapie own goal afta Reece James  fine corner. Before, Jurrien Timber con score di winning goal for Arsenal.

todayMarch 2, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds