News-edi 1

1479 Results / Page 117 of 165

Background

National

Enugu Gov Peter Mbah Don Waka Comot From PDP Go APC

Enugu State Governor, Peter Mbah, don officially comot from Peoples Democratic Party (PDP) join All Progressives Congress (APC). He announce am during one state-wide broadcast to Enugu people. Mbah talk say e make sense to waka go APC so dat Enugu fit connect better with central government. E talk say, “There comes always time wey person gats make bold choice to determine im destiny. After plenty reflection, we decide to […]

todayOctober 14, 2025 17

National

ASUU Reject FG No-Work-No-Pay Wahala

Federal government don tell all di vice chancellors for di federal universities make dem follow di “no-work-no-pay” policy for di ASUU strike wey dey happen now. Di Ministry of Education talk say dem no happy as ASUU still dey do strike despite many calls for dialogue. Dem ask di vice chancellors make dem do headcount, report who dey work, and make sure say salary no go pay those wey no […]

todayOctober 14, 2025 10

Lagos

Ijesha, Sanya: Dirt Scatter Everywhere, Lagos Govt Ban No Dey Work

Despite plenty government warnings and enforcement, people still dey dump dirt for road side for big Lagos roads like Ijesha, Sanya, Cele, and Akewukewe inside Mushin, Surulere, and Oshodi-Isolo. Motorists and pedestrians dey face wahala as plastic bags, food waste, and building rubbish full road medians and drains, block traffic and water flow. Lagos law punish illegal dumping with fine of ₦250,000  or three months jail, but people no dey […]

todayOctober 14, 2025 20

Lagos

Lagos Dey Hype Girls: Stay Sharp, Trust Your Power

Lagos government through Domestic and Sexual Violence Agency (DSVA) don charge all girls to dey diligent for everything dem dey do. DSVA Executive Secretary, Titilola Vivour-Adeniyi, talk dis one for 2025 International Day of the Girl-Child wey dem celebrate every October 11. She talk say girls no suppose ever think say dem no reach, because dem be leaders wey dey come. Di tema dis year na say every girl deserve […]

todayOctober 14, 2025 17

Lagos

Lagos Go Start $3bn Green Line From Marina To Lekki By December

Lagos State government don talk say construction of di $3 billion Green Line rail project wey go connect Marina to Lekki corridor go start December 2025. Di Transportation Commissioner, Oluwaseun Osiyemi, yan dis one for official Lagos government X page Monday. Dem don do plenty feasibility studies and talk with stakeholders along Lekki-Epe corridor ready for di project. Di rail go take two to three years, and dem go build […]

todayOctober 14, 2025 29

Sports

Super Eagles Don Finally Land Uyo Afta Mid-Air Wahala

Di Super Eagles don finally land for Uyo, Akwa Ibom, ahead of dia final 2026 FIFA World Cup qualifier match. Dem touch ground for Victor Attah International Airport around 8:05 a.m. on Sunday afta unexpected delay wey happen for air. Di wahala start on Saturday when di team dey fly from Polokwane, South Africa, go Uyo.  Di aircraft, ValueJet wey carry players, coaches, and government officials, first stop for Luanda, […]

todayOctober 13, 2025 16

Sports

Kudus Goal Carry Ghana Go 2026 World Cup

Mohammed Kudus score di only goal as Ghana knack Comoros 1-0 for Accra on Sunday, make dem win Group I and become di fifth African team wey qualify for 2026 World Cup after Algeria, Egypt, Morocco, and Tunisia. Di Black Stars, wey dem cheer with 40,000 fans for di stadium, control di first half but no too pressure Comoros goalie. But after di break, Kudus for Tottenham show sharpness as […]

todayOctober 13, 2025 23

Sports

Rohr: “Cheetahs Ready To Die For Di World Cup Ticket”

Former Super Eagles coach, Gernot Rohr, don talk say tomorrow 2026 World Cup qualifier between Nigeria and Benin Republic na serious do-or-die, as e say di Cheetahs ready sacrifice dia lives to win am because na once-in-a-lifetime chance to play for di biggest sporting stage for di world. Rohr wey dey coach Benin now, dey one step away from history with him underrated Cheetahs wey just need draw to qualify […]

todayOctober 13, 2025 11

National

Dem Pursue Pregnant Widow From Benue Say She Thief For Shop

One heavily pregnant widow don chop banishment from Ugbema community for Buruku Local Government Area of Benue State, as dem accuse her say she dey shoplift. Tori wey reach ground talk say di woman, wey just lose her husband, dey collect small-small things from shop to feed herself, her pikin and di unborn baby. But her luck finish on Saturday, October 10, 2025, when local youths catch her red-handed and […]

todayOctober 13, 2025 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app