News-edi 1

2593 Results / Page 116 of 289

Background

Lagos

FG Open Online Package For Importers To Reduce Trade Wahala

Federal Gornment on Tuesday for Apapa, Lagos, officially don launch National Single Window project, dat is ogbonge online registration for importers. Minister of Finance, Wale Edun, na im dey ground run di parole. Edun explain say dem dey do am to reduce plenty katakata for trade, and make am easy for importers and exporters to do business.

todayMarch 25, 2026 34

Sports

Victor Osimhen Chop Knife For Im Broken Arm

Victor Osimhen don successfully do surgery for im right hand wey break during di away match against Liverpool for UEFA Champions League Round of 16. Galatasaray announce on Monday say di surgery hapun for Maslak Acıbadem Hospital for Istanbul, and di club doctor, Op. Dr. Yener İnce, na im perform di surgery. Di Turkish champions wish Victor quick recovery and hope say e go fit return to di field soon. […]

todayMarch 24, 2026 31 2

Sports

No Write Note Giv Chelsea Players – Emmanuel Petit

France legend Emmanuel Petit don clear Chelsea manager Liam Rosenior to stop passing note to players. Petit tuk dis one during im chat with Talksport, after Chelsea lose 3-0 to Everton for Premier League. E tuk say Rosenior dey shame imself with di paper, because players no be children, dem no need all dis kind writing. Petit explain say whenever Rosenior try show substitution note to players wey dey come […]

todayMarch 24, 2026 29

Sports

Nasarawa United Tear Rivers United 4-1 For Lafia Stadium

Rivers United don enter anoda wahala for dia title chase  lossing 4-1 to Nasarawa United for Lafia City Stadium on Monday. Coach Finidi George bin tuk say dem go like return back to di top of di table after Rangers win 2-0 on Sunday, but Nasarawa quick goals spoil dia plan. Ngei Oluka-Efor and Abubakar Abdullahi quick quick score two goals for Nasarawa, while Chimezie Victor add another, before Taiwo […]

todayMarch 24, 2026 20

obodo oyinbo

Colombian Military Plane Crash Kill 66+Pesin, 4 Still dey Miss

Say plenti pipo na im kpai afta one Colombian military plane wey carry 125 pesin crash on Monday. According to  Minister of Defence Pedro Sanchez tuk, Di C-130 Hercules plane, wey Lockheed Martin make, crash shortly afta e lift from Puerto Leguizamo, near Ecuador and Peru border, strewing fire and wreckage for jungle floor. Sanchez explain say di plane hit ground just 1.5 km from takeoff, make ammunition blow, catch […]

todayMarch 24, 2026 23

obodo oyinbo

U.S, IRAN Battle Words For Peace Tuks

U.S and Iran  dey yarn different tori about, if dem go fit talk over di war. Presido, Donald Trump  say, e  stop im plan to attack Iran power plant after e get "productive" gist with Tehran. But Iran parliament oga tuk say no tuk don happen, e call am "fake news." Nor forget say IRAN bin threaten to close di full strait of Hormuz, if US try nonsense with di […]

todayMarch 24, 2026 25

Sports

Nigeria Shock Ghana, Win By 136 Runs For Patricia Kambarami Cup

Nigeria carry better all-round play beat Ghana by 136 runs for di Patricia Kambarami Cup wey dey happen for Lagos. Naija captain Piety Luck and Victory Igbinedion na im wan finish Ghana, make 44 runs for three overs, while Christabel Chukwuonye carry di innings go reach 159 for four. For Ghana side, matter scatter as dem lose five wickets for only 13 runs early, never fit recover. Nigeria bowler Peace […]

todayMarch 23, 2026 22 2

Sports

NPFL Match Day 31: Katsina, Kano, Remo, Rangers Record Win

For Sunday matas, the NPFL nor dey slack at for match day 31  as top teams  fight for points. Katsina United FC beat Shooting Stars FC 1-0, while Kano Pillars FC show power with 2-0 win over Enyimba International FC. Remo Stars FC carry 3-1-win comot for Kwara United FC, and Enugu Rangers FC waka go 2-0 against El-Kanemi Warriors FC. Some games like Warri Wolves FC vs Bendel Insurance […]

todayMarch 23, 2026 27

Sports

Lookman Score Historic Goal, But Real Madrid Still Shock Atletico 3-2

Ademola Lookman don make history as e become first Nigerian wey score for Madrid derby, but e goal no sti hellep as 10-man Real Madrid turn game around to win 3-2 against Atletico Madrid for La Liga on Sunday. Lookman don score two goals dis season for im debut campaign in Spanish top flight. Di win give Real Madrid (69 points) reduce Barcelona (73 points) lead to just four points […]

todayMarch 23, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds