News-edi 1

2345 Results / Page 192 of 261

Background

National

Court Order NDLEA To Seize Pretty Mike Nightclub Over Drug Wahala

Di Federal High Court wey dey Lagos don order make one property wey belong to socialite and entertainer, Pretty Mike, dey under interim forfeiture after NDLEA accuse am say e use am keep and distribute drugs. Na Justice Musa Kakaki give di order on Tuesday after NDLEA lawyer, Mr. Buhari Abdullahi, carry motion go court. Di property, wey dey No. 7 Akin Adesola Street, Victoria Island, known as Proxy Lagos […]

todayNovember 5, 2025 26

Entertainment

Ned Nwoko Talk Say Regina Must Come Back Home Before Dem Free Sammy – Family

Regina Daniels’ elder brother, Sweezy, don raise alarm say dia younger brother, Samuel Daniels wey people sabi as Sammy West, don go missing after police arrest am for Lagos on Monday, November 3, before dem reportedly carry am go Abuja. According to reports, Sweezy drop message for Instagram accuse Senator Ned Nwoko of intimidation, talk say dis one no be ordinary arrest again. E  yarn say Sammy never get lawyer, […]

todayNovember 5, 2025 62 4

Entertainment

Regina Daniels Mama Talk Say Ned Give Police Money Make Dem Beat Her Pikin

Actress Regina Daniels’ mama, Rita Daniels, don cry come out say billionaire senator, Ned Nwoko, give police money make dem beat her pikin dem. Di woman raise alarm say her children don dey suffer for police hand for over seven hours as she beg Nigerians make dem come to her rescue. Dis wahala start after Regina Daniels herself come out accuse her husband, Ned Nwoko, say him send police go […]

todayNovember 4, 2025 18 2

Entertainment

Why I Dey Fear To Marry – Don Jazzy

Mavin Records oga, Don Jazzy don open up again about why e still dey single, say e dey fear marriage and di reason don make fans dey talk for online. As e yarn about love and relationship, di award-winning producer say sometimes e dey happy when e see couples wey dey enjoy dia love for social media, but e go come begin worry when e read about divorce and broken […]

todayNovember 4, 2025 44 2 2

Entertainment

Falz Talk Say Nigeria Condition Don Dey Depress Am

Nigerian rapper and activist, Folarin Falana wey everybody sabi as Falz, don talk say di wahala wey dey happen for Nigeria don dey make am feel depressed, especially as di level of tribal and religious tension dey rise every day. Falz yarn dis one after di gbege wey burst between Christian and Muslim youths for social media, afta report say former US President, Donald Trump, threaten to launch military action […]

todayNovember 4, 2025 22

Entertainment

Waje Don Clear Air, Say She Never Date M.I Abaga

Naija singer Aituaje Iruobe, wey everybody sabi as Waje, don finally open up about di long-time rumour say she and veteran rapper M.I Abaga bin dey date. Di singer yarn di matter for The Honest Bunch podcast, where she clear say she and M.I never date before, despite wetin many people don believe since dem drop di hit song “One Naira” in 2010. According to Waje, na di romantic theme […]

todayNovember 4, 2025 33

National

APC Don Vex: “Peter Obi Dey Joy Anytime Nigeria Dey Suffer Wahala”

Lagos State APC don blast Labour Party presidential candidate, Peter Obi, over di way e respond to US decision wey put Nigeria as “country of particular concern.” Di party yarn say Obi dey use di sensitive mata do political gain instead of show real leadership and patriotism. Hon. Seye Oladejo, di party spokesperson, yan on Tuesday say Obi comment come too late and e dey politically motivated. Oladejo talk say […]

todayNovember 4, 2025 18

National

“No Christian Genocide Dey Happen For Nigeria” – Chief Of Defence Oluyede Don Clear Di Air

Nigeria Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede don clear di air say no be Christian genocide dey happen for di country, but na terrorism wey dey affect all Nigerians whether dem be Muslim or Christian. Dis one follow after U.S. President Donald Trump recent talk wey him express worry say Christians dey face attack for Nigeria and even threaten military action if government no act. Oluyede talk say, “We […]

todayNovember 4, 2025 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds