News-edi 1

2593 Results / Page 211 of 289

Background

International

Rich Countries Don Drop Hand For Climate Fight — Cop30 Chief

Rich countries don lose energy to fight di climate wahala, but China don dey move strong for clean energy matter, na wetin André Corrêa do Lago, di Brazilian diplomat wey be Cop30 oga, talk as di UN climate meeting go start for Belém inside Amazon forest. E say instead of dem to dey complain say China don overtake dem, countries suppose copy China way wey don turn di biggest producer […]

todayNovember 10, 2025 47

National

Student Beat Teacher Till E Kpai On Top Gambling Gbege For Oyo

One teacher for Soun High School, Mr. Fatai Adegoke, don kpai after im own students brutally attack am while e dey try stop dem from gambling for school hours. Reports talk say Mr. Adegoke reprimand some students wey dem catch dey gamble for classroom, and di students come attack am back, break im bones and injure am bad. E rush hospital but later die from di injuries wey dem give […]

todayNovember 10, 2025 34

National

Army Rescue NYSC, INEC Officials Wey Dem Hold Hostage For Awka — 82 Division

Di Nigerian Army don clear mouth say di viral video wey dey claim soldiers dey involve for electoral malpractice for Anambra State no true. Di Army talk say di soldiers dem only dey deployed to rescue NYSC and INEC officials wey suspected political thugs hold hostage during Saturday governorship election. Lieutenant Colonel Olabisi Ayeni, Deputy Director, Army Public Relations, yarn for statement wey dem title “Clarification on Nigerian Army Intervention […]

todayNovember 10, 2025 22

National

Police Nab Six, Recover Stolen Pikin For Inside Anambra

Di Anambra State Police Command don rescue one three-year-old pikin wey dem thief for di state and don arrest six members of one child-stealing and trafficking gang wey dey operate for Anambra, Enugu, and Lagos. According to Tochukwu Ikenga, di Command spokesperson, di matter start on September 4 after di victim write petition give di Gender Unit for State CID, Awka. E talk say di complainant’s daughter leave her three-year-old […]

todayNovember 10, 2025 35

Lagos

Lagos Seal Three Fresh Deals To Turn Dirty Waste To Big Money

Di Lagos State government don show say e serious to take waste management to next level as dem sign three MoUs with big companies. For di 11th Lagos International Climate Change Summit wey hold for Continental Hotel, Victoria Island, di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, talk say dem wan move from di old “pick and dump” system go sustainable waste-to-wealth model. Di new deals go reduce how […]

todayNovember 10, 2025 35

National

“Useless Black African People!” – Nnamdi Kanu Vex For Judge Inside Court

Nnamdi Kanu, wey be di leader of Indigenous People of Biafra (IPOB), don para for court today, November 7, as e face im terrorism trial. Kanu wey dey defend himself refuse to open im defence, instead e burst vex for di judge, talk say di judge no sabi wetin justice mean. “You no know wetin justice mean. You no even get idea of wetin justice be,” Kanu talk. E come […]

todayNovember 7, 2025 77 1

Sports

Morocco Go Host 2025 CAF Awards For November 19

Di Confederation of African Football (CAF) don confirm say di 2025 CAF Awards go shele for Rabat, Morocco on Tuesday, November 19 by 7 p.m. local time (same as Naija time). According to wetin CAF yarn for dia website on Friday, di big ceremony go celebrate Africa best footballers, coaches, clubs and national teams wey don shine for di past year. Naija go show face well-well for di event as […]

todayNovember 7, 2025 39

National

FEC: Tinubu Government Go Build Houses For Abuja Judges

Di Federal Executive Council (FEC) don approve di construction of official residences for heads of key federal courts and also give go-ahead for major water and infrastructure projects across di Federal Capital Territory (FCT). Di FCT Minister, Nyesom Wike, reveal dis one as e brief State House correspondents after di FEC meeting wey President Bola Tinubu preside over for Presidential Villa, Abuja. Wike talk say di approval include design and […]

todayNovember 7, 2025 21 3

National

2026 Hajj: NAHCON Don Complete Hotel And Kitchen Check For Madinah

Di National Hajj Commission of Nigeria (NAHCON) don talk say dem don finish strategic inspection of accommodation and catering facilities for Madinah as part of early preparation for di 2026 Hajj operations. NAHCON yaRn dis one for statement wey Ahmad Muazu, Technical Assistant to di NAHCON Chairman on Media, release. Muazu talk say di inspection exercise happen from November 3 to 5 and na Prof. Abubakar Yagawal, Commissioner wey dey […]

todayNovember 7, 2025 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds