News-edi 1

1469 Results / Page 34 of 164

Background

Sports

Tanzania Go Make Match Hard For Super Eagles – Onazi

By: Rilwan Agbomeji Former Naija Midfielder, Ogenyi Onazi don warn say Tanzania go make life hard for Super Eagles for dia AFCON 2025 Group C match on Tuesday for Morocco. Onazi yarn for TV siddon talk say players gatz prepare well if dem wan collect full three points. Super Eagles dey favourite to top di group wey get Tunisia and Uganda join body.  

todayDecember 22, 2025 10

Sports

We Ready Well-Well To Face Nigeria – Gomandi

By: Rilwan Agbomeji Tanzania coachie Manuel Gomandi talk say im team don ready for AFCON 2025 Group C opener against Nigeria. Dem go face Super Eagles for AFCON first time since 1980. Dem lose 3-1 back then, wey Christian Chukwu lead Nigeria to di African Championship.

todayDecember 22, 2025 7

Sports

Lookman Yarn Say AFCON 2025 Cup Na For Naija

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles winger, Ademola Lookman don clear marras dat di Super Eagles ready to go di extra mile to collobi di 2025 African Cup of Nations Dis yarnings dey follow fans demand on social media mata say Naija miss out for di 2026 world via penalty to Dr Congo Lookman respond for TV siddon talk dat di team go correct di past by showing correct skills and […]

todayDecember 22, 2025 8

National

Naija And US Sign $5.1bn Agreement To Join Hand For Health Sector

By: Rilwan Agbomeji US don agree five-year health deal with Naija to help di country guide for health matas and boost church hospitals make country health system strong and boost church hospital dem. US Deputy tuk tuk person, Thomas Pigott, yarn dis one wrap am like groundnut send giv news pipo on Saturday. Pigott yarn say US go drop nearly $2.1bn for HIV, TB, malaria, polio plus mama and pikin […]

todayDecember 22, 2025 6

National

FG Declare Say Kidnappers And Bandits Na Terrorists

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don cut rope follow say any kidnapper or bandit go face di music just di way dem take dey treat terrorists. Minister of Information, Mohammed Idris na im carry di mata for head as e take serious reach, siddon tori pipo dey tell dem for Abuja how di federal govment ready to wipe out any jaguda boi wey no wan allow Nigeria drink water keep […]

todayDecember 22, 2025 12

National

Presido Tinubu Arrange Nepa Man Dr. Mulisiu Oseni As Nerc Chairmo

By: Rilwan Agbomeji Presido, Bola Ahmed Tinubu don appoint  ogbonge  nepa man Dr. Mulisiu Oseni, as new chairman of di Nigerian Electricity Regulatory Commission afta senate confirm di board members for abuja. Dis one mean say,  presido Tinubu don drop Abdullahi Ramat wey im nominate earlier to replace former Chairman, Sanusi Garba. According to presido tuk tuk persin, Bayo Onanuga, di move na to make sure say strong and effective […]

todayDecember 19, 2025 18

foreign

EU Give Ukraine €90 Billion Loan Say Make Dem Use Am Guide Dia Economy

By: Rilwan Agbomeji Unto marras for di Ukraine war, say like dis, European union don join bodi arrange €90 billion loan for Ukraine say make dem use am take guide, as dia economy dey cry because of war blood. According to report, di Ukraine economy don worwor and that I worwor pass atutuporyoyo Di deal come afta plenty talks for brussels summit, wey Ukraine request more fund because of dia […]

todayDecember 19, 2025 5

Sports

Alonso Dey Fight Make E Still Get Im Job – Tote

By: Rilwan Agbomeji  Former Real Madrid striker, Tote, don yarn say manager Xabi Alonso dey fight to keep im job for di club. Tote yarn dis for one siddon talk show say decision to sack Alonso don almost ready as confidence don low for am. E yarn say Xabi dey struggle every three days to prove himself, and di pressure na heavy for am. According to Tote, some people no […]

todayDecember 18, 2025 13

foreign

Flood Force Thousands To Run Comot For Malaysia

By: Rilwan Agbomeji Bad flood don force thousands to comot from dem house for Malaysia on Thursday. For Pahang state, 8,226 people don waka go temporary evacuation center, up from 3,796 the day before. Johor get 347 people, Terengganu 913, while Kelantan don evacuate 16 people. Flood, landslide, storm, and cyclone don scatter South and Southeast Asia, with Indonesia report over 1,059 dead, Sri Lanka 640, and Malaysia 3 confirmed […]

todayDecember 18, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app