News-edi 1

2334 Results / Page 33 of 260

Background

Lagos

How Domingo Adeleke Go Kpai For Switzerland

By : Jolayemi Olajide Nor be small cry Naija delegation dey cry for Geneva, Switzerland , say Lagos State Join bodi tuk, tuk, Council Chairmo, Domingo Michael Adeleke, kpai on Tuesday. Adeleke travel go Switz to represent Naija workers for the 114th Session of the International Labour Conference before brief sickness wire am down. Na One top official of the Nigeria Labour Congress (NLC) konfam di sad update, hailing Adeleke […]

todayJune 9, 2026 14

Lagos

Lagos Apc Choose State Deputy Woman Leader Damilola James As Hamzat Running Mate

By : Jolayemi Olajide Lagos State APC don formally announce di party state Deputy Woman Leader, Princess Damilola James, as di running mate to dem gofnorship candidate, Dr. Obafemi Hamzat, ahead of di 2027 election. Oga Lagos APC Chairmo, Cornelius Ojelabi, naim break di news inside statement on Monday, revealing say di choice of di Badagry-born princess, na based on agreement wey di house agree. Ojelabi hail madam Damilola, say […]

todayJune 9, 2026 14

General

How Kidnappers Dey Target Victims Through Social Media

For old days, if kidnappers wan pick person, dem go need informant, follow person physically, or get insider wey know di victim well well. But nowadays, things don change. Na so-called “harmless” social media post don turn their biggest tool. Plenty criminals no even need stress again, na victims dey give dem full informate like gift. Security experts don warn say kidnappers and other criminals now dey use Facebook, Instagram, […]

todayJune 9, 2026 13

Sports

Super Falcons Show Power

Nigeria Super Falcons show say dem ready oh for WAFCON 2026, beating  Senegal 3-0 for dia second friendly match for Ikenne, Ogun State. Di win complete double victory for di African champions after dem first beat di Teranga Lionesses 2-1 on Friday. Coach Justin Madugu and im players dominate di game from start to finish, create plenty chances even though Senegal defence try hold ground for first half. Di result […]

todayJune 9, 2026 9

obodo oyinbo

WHO Give Uganda Big Respect

Di head of di World Health Organization, Tedros Adhanom Ghebreyesus, don hail Uganda as dem dey try well-well to stop di Ebola virus from spreading enter inside dia country. Oga Tedros, wey visit Mulago National Referral Hospital for Kampala on Monday, talk say Uganda really dey handle di matter sharply. Dis praise dey come after WHO declare di Ebola outbreak a heavy international emergency, as di sickness don kpai 91 […]

todayJune 9, 2026 7

OBODO NAIJA

Senate Push For State Police

Senate don drop microsoft word say dem go begin urgent discussion on state police dis week to hellep tackle di rising insecurity for di country. Senate Leader, Opeyemi Bamidele, naim tuk dis one for statement, say di mata don become top priority inside di ongoing constitutional review process. Im say dem don already dey meet stakeholders and dem go quick pass di bill so e fit move go state assemblies […]

todayJune 9, 2026 10

OBODO NAIJA

President Tinubu Replace Adelabu, Tuggar With New Ministers

Wi oga Presido, Bola Tinubu don go swear for two new ministers, Joseph Tegbe as Minister of Power and for Sola Enikanolaiye as Minister of State for Foreign Affairs for Aso Villa, Abuja. Di swearing-in ceremony hapun on Monday inside di Council Chamber with top gornment officials and family members present. Di appointment follow di resignation of former ministers Adebayo Adelabu and Yusuf Tuggar, wey leave office to contest election […]

todayJune 9, 2026 13

Lagos

Vice Presido, Shettima Hail Tinubu

Vice Presido Kashim Shettima on Monday say Nigeria plan, na to build one-trillion-dollar economy, wey investors go package across all levels of gornment. Im tuk dis tuk one wen e open di Invest Lagos 3.0 Summit for Eko Hotel and Suites, Victoria Island, Lagos. Shettima also praise Presido, Bola Tinubu, say im  ma try oh, even though plenty Nigerians nor dey see dat oga presido try, as im take transform […]

todayJune 9, 2026 11

Sport Yarns

Alex Iwobi Thank Nigerians Say im Wan Play Im 100th Game For Super Eagles

By : Jolayemi Olajide Super Eagles star midfielder, Alexander Iwobi, don send big thank you to all Nigerians for home and abroad for di heavy love and support as im prepare to play im 100th match for Nigeria against Portugal inside Leiria on Wednesday. Inside one sharp tuk on Monday, naim di playmaker take fry mouth tuk di tuk. Iwobi say im dey very proud to wear di green and […]

todayJune 8, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds