News-edi 1

1370 Results / Page 65 of 153

Background

Entertainment

Burna Boy Chase Couple Comot For Dey Sleep For Im Concert

Grammy winner and Nigerian music star, Burna Boy, don cause another wahala again after e order one couple comot from im concert for Denver, United States, on Wednesday night because dem sleep while e still dey perform. Di drama start when Burna Boy pause im performance and vex say di guy girlfriend dey sleep for front row. “When I stand up here and see you with your girl sleeping in […]

todayNovember 13, 2025 38

National

Naira Don Record Highest Crash Against US Dollar

Naira don record highest crash against US dollar dis week, data show. On Wednesday, official forex market rate show say Naira don fall reach N1,443.08 per dollar, down from N1,438.71 wey e trade on Tuesday. Dis mean say Naira drop N4.3 against dollar in one day. For black market, Naira still steady at N1,465 per dollar, same as Tuesday. According to reports, Wednesday crash na di highest depreciation dis week, […]

todayNovember 13, 2025 14

National

Naija Govt Suspend 15% Petrol Import Duty

Di Nigerian Government don suspend di 15% import duty wey dem bin wan put for petrol (PMS) and diesel (AGO). Di spokesperson of di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA), George Ene-Ita, yarn dis one for statement on Thursday. E beg Nigerians make dem no panic buy fuel or diesel, say petrol dey ground well-well across di country. NMDPRA talk say di 15% ad valorem import duty no […]

todayNovember 13, 2025 11

National

Wike Suppose Get National Apology For Clash With Naval Officer – PANDEF

Di Pan Niger Delta Forum (PANDEF), wey be di top socio-political body for South-South zone, don yarn say di Minister of Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, deserve national apology afta dem stop am from doing im work because one Naval officer and oda people. For one statement on Thursday, di National Chairman of PANDEF, Ambassador Godknows Igali, beg President Bola Tinubu make e direct di security and law enforcement […]

todayNovember 13, 2025 10

National

Soldiers Rescue 74 NYSC Members From Kidnap Attempt For Borno

Troops of Joint Task Force (JTF) wey dey operate under Operation Hadin Kai don rescue 74 NYSC members wey Boko Haram/ISWAP nearly kidnap for Buratai–Kamuya road inside Borno State. Di wahala happen Tuesday night as dia motor break down for one area wey dem sabi say kidnappers dey operate. Around 9:05pm, soldiers rush reach di scene after CCTV wey army dey monitor show suspicious movement of three buses. When dem […]

todayNovember 13, 2025 10

Lagos

Lagos Seal One Restaurant Wey Break Environmental Law

Di Lagos State Government don seal one popular restaurant wey dem call Ejanla Restaurant for No. 40 Fola Osibo Street, Lekki, because e dey break environmental law. According to di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, di Lagos State Wastewater Management Office (LSWMO) discover say di restaurant dey pump raw sewage enter public drainage with machine, wey come cause bad smell, pollution, and danger to human life. Wahab […]

todayNovember 13, 2025 12

Sports

From 1981 To 2025: How Bonus Wahala Don Scatter Nigeria World Cup Dreams

Super Eagles don resume training ahead of Thursday’s World Cup playoff against Gabon for Rabat, but history show say di wahala from dia short strike fit don already affect dem. For di past four decades, every player strike or pay wahala for national team don dey come with painful loss wey dey spoil Nigeria World Cup dreams. Di pattern start from 1981, wey Nigeria miss Spain ’82 World Cup after […]

todayNovember 13, 2025 14

Sports

Falconets Finish WAFU B Tourney Unbeaten

Nigeria U-20 women team, di Falconets, don finish dia 2025 WAFU Zone B U-20 Women’s Cup campaign for Benin Republic with clean slate as dem beat di hosts 1–0 for Omnisport Stadium, Adjohoun on Wednesday. Dem don already sabi say dem be champions before di final match, but dem still maintain 100% record thanks to 16th-minute goal wey in-form striker Ramotalahi Kareem score. Kareem follow precise through ball, shake off […]

todayNovember 13, 2025 8

Sports

Osimhen, Aubameyang Dey Lead Battle For Rabat Between Nigeria And Gabon

Na today, Nigeria go face Gabon for one of di semi-final of 2026 World Cup African playoffs for Complexe Sportif Prince Heritier Moulay Al Hassan for Rabat, Morocco. Na all-or-nothing gbege be dis as di winners go face di other semi-final winner for di final on Sunday, and di winner go enter di intercontinental playoffs by March 2026. For today’s clash, e go be di 10th time wey Nigeria and […]

todayNovember 13, 2025 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app