News-edi 1

2345 Results / Page 67 of 261

Background

obodo oyinbo

Gulf War Fit Trigger Food Insecurity Surge – IMF

International Monetary Fund don drop warning say food wahala fit scatter well-well for Nigeria and other African countries as Gulf War disruption dey shake economy, dey threaten di small recovery wey di region just dey try hold. Dem talk dis one as 2026 Global Report on Food Crises show say war, drought, plus reduction in aid go keep hunger level for world high, especially for countries wey already dey weak […]

todayApril 25, 2026 20

obodo oyinbo

Palestinians Line Up Vote for First Election Since Gaza War

Palestinians for West Bank and one central part of Gaza don start to vote on Saturday for municipal elections. Dis na di first voting since Gaza war, as political options tight and many people no too get hope. About 1.5 million people register to vote for Israeli-occupied West Bank, plus 70,000 people for Deir el-Balah area for Gaza, according to Central Elections Commission wey dey Ramallah. Video from Al-Bireh for […]

todayApril 25, 2026 14

Sports

Why I Comot Mbappé For Real Betis Game – Álvaro Arbeloa

Real Madrid coachie, Álvaro Arbeloa don explain why e sub striker Kylian Mbappé during dia LaLiga 1-1 draw with Real Betis on Friday. For post-match interview, Arbeloa tuk say say Mbappe feel discomfort during di game against Betis. E sti tuk say dem go see how e go be for coming days. Real Madrid go now face Espanyol for dia next match.

todayApril 25, 2026 17 1

OBODO NAIJA

Police Rescue Two-Year-Old Pikin Wey Jaguda Boys Carry for Kano

Kano State Police Command don rescue one two-year-old boy wey jaguda boys carry, dem still grab three suspects and recover ₦930,000 from di ransom wey family pay. Police tuk dis one for statement wey dem drop on Saturday, wey Police PRO Abdullahi Kiyawa sign, as e break down how di pikin take miss and how police track di matter use correct informate go bring am back. Kiyawa talk say di […]

todayApril 25, 2026 17

Sports

NFF Wan Make Osula Play For Super Eagles

Nigerian Football Federation (NFF) don enter William Osula matter, dey try convince am make e switch play for Nigeria national football team. Osula, wey dey play for Newcastle United for Premier League, fit play for Nigeria through im papa side. Di 22-year-old get Danish mama and French-Nigerian papa. Even though e don play for Denmark youth level before, e still dey show say im get strong link to Nigeria.

todayApril 23, 2026 21

obodo oyinbo

Iran Tankers Still Dey Pass US Blockade For Hormuz

According to Financial Times report on Wednesday, at least 34 tanker ships wey get link to Iran still dey waka pass Strait of Hormuz for recent days, even though US dey block di Strait. But US Presido, Donald Trump sti talk say America “fully control” di Strait of Hormuz, and claim say di blockade strategy dey work well well. On April 13, US put blockade wey dem talk say go […]

todayApril 23, 2026 21

OBODO NAIJA

Senator Oluremi Tinubu Launch Federal Government Industrialisation Programme for Kano

Senator Oluremi Tinubu don launch “Energise Commercialisation Now” programme, wey go help turn research ideas to real money and industry for Nigeria on Thursday for Kano State. Di initiative na Federal Government plan to push innovation, attract investors, and boost production for all six geo-political zones. Di event wey carry theme “From Innovation to Industry” dey try close gap between ideas for school and research centres and how dem go […]

todayApril 23, 2026 13

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Ask Senate Make Dem Approve Fresh $516.3m Loan

Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don ask Senate make dem approve fresh $516.3 million loan from Deutsche Bank to take finance one road project. Di request dey inside letter wey dem read during plenary on Thursday to Senate Presido, Godswill Akpabio. According to di letter, di loan go fund Sections 1, Phase 1a and 1b of Sokoto–Badagry Superhighway, one major road project of about 1,000km, with 120km for current […]

todayApril 23, 2026 12

Lagos

Skip Sanitation and Collect Punishment – Lagos Government Warn Residents

Lagos State Government don warn residents across di state make dem fully join di monthly environmental sanitation wey dem fix for Saturday, April 25, or dem go collect wotowoto. Di Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, drop di warning for statement on Wednesday, say make residents for all five divisions of Lagos stay for house between 6:30am and 8:30am to clean dia surroundings. Im talk say residents suppose […]

todayApril 23, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds