News-edi 2

1807 Results / Page 193 of 201

Background

National

Tinubu Fix October 6 As Deadline for NERD Compliance for NYSC Mobilisation

President Bola Tinubu don use him power under NYSC Act approve say every graduate gatz follow the Nigeria Education Repository and Databank (NERD) Policy before dem fit do NYSC or even collect exemption. This new rule wey dey inside Sections 2(4)(4) and 16(1)(C) of the NYSC law, na part of circular wey the Secretary to the Government of the Federation, Senator George Akume, don sign and send give everybody. According […]

todaySeptember 29, 2025 73

National

Give us Ibadan State before 2027 — Olubadan talk Tinubu

The new Olubadan, Oba Rashidi Adewolu Ladoja, don talk say make dem create new state wey go be Ibadan State. As e dey talk to people for Ibadan after Governor Seyi Makinde give am Staff of Office, Oba Ladoja ask President Bola Tinubu make e try make sure say Ibadan State dey before 2027. For Yoruba, Oba talk say, “My people don send message go Mr President. Mr President, dem […]

todaySeptember 26, 2025 33

International

UNGA 80: Tinubu No Show Fit Be Strategy – Trump Fit Embarrass Am For Nothing, Ex-NIIA DG Talk

Prof. Akinterinwa, former Director-General of the Nigerian Institute of International Affairs (NIIA), don talk say President Bola Tinubu absence from the 80th United Nations General Assembly (UNGA) for New York fit be strategic move to avoid any unnecessary embarrassment from former US President, Donald Trump. As e dey, Akinterinwa explain say even though Vice President Kashim Shettima represent Nigeria for the summit, him no dey on the same level with […]

todaySeptember 26, 2025 40

National

Alleged Terrorism: Court Throway Nnamdi Kanu No-Case Submission, Order Am Make E Open Defence

Federal High Court for Abuja don throway the no-case submission wey Nnamdi Kanu, self-acclaimed leader of the Indigenous People of Biafra (IPOB), file for him ongoing terrorism case. Justice Omotosho wey deliver the ruling on the matter talk say the Federal Government don show enough evidence wey suppose make Kanu enter witness box go defend himself. The judge talk say the evidence wey prosecution carry come court, plus the exhibits […]

todaySeptember 26, 2025 51

International

People waka comot as Netanyahu Deny say Gaza dey Suffer ‘Genocide’ and Hunger for UN Speech

Israel Prime Minister, Benjamin Netanyahu, don deny accused say dem dey do “genocide” for Gaza or dey use “starvation” as weapon. He talk this one on Friday for United Nations General Assembly for New York. Netanyahu talk say instead of starving Palestinians, Israel dey even help feed people for the war-torn Gaza. According to am, “People wey dey carry fake story say Israel dey do genocide no better pass those […]

todaySeptember 26, 2025 26

Local

Construction workers trap inside Anambra three-storey building wey collapse

One three-storey building wey still dey under construction don collapse for Okpuno, Awka, Anambra State capital, near the Anambra State House of Assembly, off Ekwueme Square, around 11:40am on Thursday. The building wey get four suspended floors still dey for roofing stage when e suddenly fall, scatter everywhere, and throw people for the area into panic. People wey see as e happen talk say the building no give any sign […]

todaySeptember 26, 2025 36

Local

Police Rescue 4-Year-Old Girl Wey Child Traffickers Sell for ₦3.7 Million for Ondo

Ondo State Police Command don rescue one 4-year-old girl wey child traffickers allegedly sell for ₦3.7 million as part of a big trafficking network wey dey operate for Ondo, Delta, and Anambra states. Police spokesperson, SP Ayanlade Olayinka, call di rescue and bust of di syndicate “a major breakthrough” for di fight against human trafficking. Di matter start when one man, Sunday Kingsley from Alagbaka Extension, Akure, report say him […]

todaySeptember 26, 2025 63

National

Dangote Refinery Sack All Nigerian Workers 24 Hours After Dem Join PENGASSAN

Di management of Dangote Petroleum Refinery don sack all di Nigerian workers wey dey work for dia company. One political commentator, Imran Wakili, share di statement on top X on Wednesday. “Dangote Refinery don officially lay off all e Nigerian workers under di disguise of 'reorganisation', just less than 24 hours after 90% of dem join PENGASSAN,” Wakili talk. According to am, di sack happen shortly after majority of di […]

todaySeptember 26, 2025 40

Lagos

Clean Water Supply: Lagos Wan Concession 7 Mini and Micro Waterworks

Lagos State Government don show plan to concession seven mini and micro waterworks to private investors as part of effort to improve clean water supply under their 2025–2030 Strategic Business Plan. Di pilot scheme go cover waterworks wey dey for Lekki, Akilo, Victoria Island Annex, Magodo, Abesan, Alexander, and Apapa. According to Lagos Water Corporation (LWC), dem go run di project through Public-Private Partnership (PPP) wey go help repair, upgrade, […]

todaySeptember 26, 2025 41

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds