OBODO NAIJA

Police Beg Naija People Make Dem No Attack Policemen

todaySeptember 18, 2026

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Cross River State Police Command don beg Nigerians make dem respect police officers wey dey do dem lawful duty.

Police PPRO, ASP Sunday Eitokpah, tuk say police uniform na symbol of public authority, but pipo dey inside the uniform too.

Dem dey risk dia lives every day to answer emergency calls, prevent crime, protect lives and property, and maintain peace.

E warn say assault, block or resist policemen violently no good, as e fit weaken respect for law and gornment authority.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds