Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Bandits don kill one Islamic cleric for Toro Local Government Area of Bauchi State, Muhammad Bakoshi, after dem raid di area for early morning on Saturday. Information wey reach us show say di bandits, whose identity dem never fit confirm as at press time, attack di house of di late Islamic cleric. Before him death, Bakoshi bin be di Discipline Officer of Jama’atu Izalatil Bid’ah Wa Iqamatus Sunnah (JIBWIS), Zalau.
Di bandits still kidnap di cleric wife wey just born two weeks ago, along with her daughter, carry dem go unknown destination. Di sad incident don throw di whole community into fear and grief as dem don dey exposed to bandits attack for recent times. Meanwhile, Bauchi Police Command never officially react to di matter as at di time we dey file dis report.
Written by: News Editor 2
Bandits Bauchi Bauchi bandit attack
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025