Kano State House of Assembly don start impeachment process for Deputy Governor Aminu Gwarzo, dem dey accuse am say e dey misuse office.
Dis  yawa dey sup after Governor Abba Yusuf kawa go join All Progressives Congress from New Nigeria People’s Party.
Di Majority Leader, Lawal Dala, carry di motion come for plenary wey Speaker Ismail Falgore dey lead.
Dala talk say dem dey do am follow Section 188 of Nigeria Constitution (1999) wey allow state assembly to impeach deputy governor wey dem find do bad work.