According to update from wi international airport say wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu no really cancel di cashless policy wey Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) introduce, but say, make dem adjust am to make life easy for Nigerians.
U sabi say for FEC meeting on Wednesday, Aviation Minister Festus Keyamo bin say, Baba Seyi  order, make dem stop di policy immediately.
Addressing tori pipo for Lagos on Thursday, FAAN boss Olubunmi Kuku say di President instruction na good thing and dat dem don already arrange hybrid process to make everything go wiririwerere