By : Jolayemi Olajide
Taiwan Presido, William Lai Ching-te don talk say him belle dey sweet am to yarn with US Presido, Donald Trump, say na move wey fit scatter over 40 years diplomatic protocol and fit vex China.
Trump tell tori pipo on Wednesday say e go call Lai, as White House dey plan to sell heavy weapons and arms package giv Taiwan.
Since Trump return from im meeting with Chinese Presido Xi Jinping for Beijing last week, na di second time wey e dey talk say e go call Taiwan leader.