By: Esther Ayoola
Benue state Govo, Hyacinth Iormem Alia don praise security agencies as dem successfully rescue passengers wey kidnappers carry from Benue Links bus for Makurdi–Otukpo road.
Di governor tuk dis one on Sunday, when e receive di freed victims for Old Banquet Hall inside Government House for Makurdi.
E thank di Commissioner of Police and other security operatives for dia strong effort wey make di rescue possible.
Alia sti promise say im gornment go continue to fight insecurity make pipo for Benue fit dey safe.